BREAKING NEWS

Friends, justt got this and am still laughing............
China is not satisfied with her Olympic performances after winning 81 medals as at today,
(almost 100 medals this time 4 yrs ago) they plan to overhaul their Olympic organization for better performance in subsequent Olympics.
 
Meanwhile as at today Nigeria is yet to win a single medal with a contingent of 200 officials and 53 athletes and a budget of $5.3m USD
(N850m) for a 3week outing. They should all be arrested on arrival
​I dey vex 4 dis country wey I come from no be joke oooo!!!
Small thing Ogoni man go jump enter water like fish for days we no go see dem.
See Olympics nah, go swim, dem dey fear water…
Hausa man go enter boat dey shout argungu fishing festival.
See rowing 4 Olympics, dem no dey…
Fulani herdsmen fit shoot arrow from 1km kill anyone wey wan steal dem cow.
Olympics reach make dem go do archery, dem no sabi shoot again
Igbo man go run from Sokoto to Aba at the slightest provocation by Boko Haram.
See marathon 4 Olympics, dem no show face
Agbero for park no mind pursue bus for road.
See 100metres race 4 Olympics, dem no sabi run again
Yoruba man go remove clothes, wrist watch and pant to fight 4 Ojuelegba.
See boxing 4 Olympics, we no see dem
Warri man go say “Warri no dey carry last”..... na wetin Blessing Okagbare,
our own Warri babe dey do for last 4 women 200metres race 8 -1.
Abi she think say one person dey her back?
Na who even start that nonsense called NAIJA GOT TALENT sef?
We Go See Watin We Fit Do Next 4yrs….. E Go Better. Na When?
 
 

Comments

Popular posts from this blog

Over 60 hot small businesses you can start with less than N50, 000(naira)/about $320(dollars)

LIST OF GOOD RECRUITMENT AGENCIES IN LAGOS

CULTISM IN NIGERIAN UNIVERSITIES

HAVE YOU READ THESE?